Originally published at: Naija Guru is under construction
Today na Sunday. My chicken for yard neva do kukuruku but I sabi sey time don reach make I wake up dey waka go market. I get dream for night wey na so-so ojuju dey pursue me. Tufiakwa! I reject am. Papa Ifeanyi still dey sleep, dey snore wit im mouth like basket. I no sabi haw I dey manage sleep wit di kind ringtone wey dey komot from im mouth every night, but once my head touch pillow like dis, I don go⦠I don too work.