Dis Na Civilized Place for Public Discussion
Abeg treat dis discussion forum with di same respect wey yu dey use treat yor work place. Dis na shared community resource — na place for people to share dia skills, knowledge and interests through conversation.
Dese rules no déy set in stone. Dem be guidelines wey we make to help yu make di right judgment, so dat we go fit keep dis community kind and friendly, and we go fit create di space for civilized public discourse.
Improve di Discussion
Mek yu help us make dis place great for discussion. Dey try add something positive to di discussion. If yu no sure weda yor post dey add to di conversation, think about wetin yu want say first kon try again later.
One way wey yu fit improve di discussion na to discover di discussions wey dey happen already. Spend time to browse di topics wey déy here before yu reply or yu start yor own. Dis way, yu go get better chance to meet oda people wey dey share yor interests.
Di topics wey people dey discuss here déy important to us, and we want sey mek yu act as if dem déy important to yu too. Mek yu déy respectful of di topics and di people wey dey discuss dem, even if yu no agree with wetin dem dey talk.
Déy Agreeable, Even Wen Yu No Gree
Yu fit want response sey yu no gree. No wahala. But remember sey na ideas yu suppose criticize. No be people. Abeg avoid:
- Name-calling
- Ad hominem attacks
- To dey resond to di tone of post rather than di actual content of di post
- Knee-jerk contradiction
Instead, mek yu provide thoughtful insights wey go improve di conversation.
Yor Participation Get Value
Di conversations wey we dey get for here dey set di tone for di new people wey dey arrive for here. Mek yu help us influence di future of di community. Mek yu choose to engage in discussions wey go make di forum more interesting — and mek avoid di ones wey go do di opposite.
Discourse get tools wey go enable di community to collectively identify di best (and worst) contributions: bookmarks, likes, flags, replies, edits, watching, muting and so on. Mek yu use dese tools improve yor own experience, and oda people experience too.
Mek yu try make awa community better pass di way e be wen yu join am.
If Yu See Problem, Flag Am
Moderators get special authority; dem déy responsible for dis forum. But yu sef déy responsible. With yor help, moderators go fit facilitate di community. We no want sey mek dem turn to janitor or police.
Wen yu see bad behavior, no reply. If yu reply, yu dey acknowledge am and yu go encourage di bad behavior. Moreover, e go consume yor energy, and e go waste everybody time. Just flag am. If enough people flag am, we go take action. E fit be automatic, or moderator go intervene.
In order for us to maintain awa community, moderators dey reserve di right to komot any content and any user account for any reason and for any time. Moderators no dey preview new posts; di moderators and site admin no go take any responsibility for any content wey community members post.
Always Déy Civil
Nothing dey sabotage healthy conversation like rudeness:
- Mek yu déy civil. No post anything wey reasonable person go consider offensive, abusive, or hate speech.
- Mek yu keep am clean. No post anything wey déy obscene or sexually explicit.
- Mek yu respect each oda. No harass or grief anybody, no impersonate people, and no expose people private information.
- Mek yu respect awa forum. No post spam and no try vandalize di forum.
No be concrete terms be dis, and di definitions no too precise — mek yu no do things wey fit appear to dey violate dese terms. If yu no sure, ask yorself haw yu go feel if dem feature yor post for front page of national news.
Dis na public forum, and search engines dey index dese discussions. Mek yu keep di language, links and images safe for friends and family.
Keep Am Tidy
Make effort to put things for di right place so data we fit spend more time for discussions and less time for cleanups. So:
- No start topic for di wrong categoryl abeg read di category definitions.
- No cross-post di same thing for multiple topics.
- No post no-content replies.
- No divert topic. No dey change di subject for middle of conversation.
- No dey sign yor posts — yor profile information go déy attached to all yor posts.
Instead of to dey post “+1” or “Agreed”, mek yu use di Like button. Instead of to dey take existing topic go anoda direction, mek yu use Reply as a Linked Topic.
Post Only Wetin Yu Own
Yu no fit post anything digital wey no be yor own without permission. Yu no fit post descriptions, links or methods wey person fit use steal people intellectual property (software, video, audio, images), or break law.
Powered by Yu
Na yu and yor friendly moderator team wey dey power dis community. If yu get any further questions about haw things suppose work for here, mek yu open new topic for Site Feedback and mek we discuss am! If matter critical or urgent sotey meta topic or flag no fit handle am, mek yu contact di moderators.